8 God Spirit, di wota and di blood and dis three witness dey tok di same tin.
So make una go make pipol my disciples for di whole world, dey baptize dem with di Papa, di Pikin and di Holy Spirit name,
Many pipol lie for Jesus head and dem dey tok difren-difren tins, but dia story nor gri with each oda.
“But wen di true Spirit wey I go send from my Papa to help una don kom, e go tok about mi.
But one soja kon take spear shuk di korna of en belle, den blood and wota kon dey rush kom out.
Dis tins gri with wetin di profets tok before sey:
Na God Spirit make us know sey wi bi God shidren.
and E don mark us as en own kon put en Spirit for awa heart, so dat wi go dey sure of all di oda tins wey E sey E go give us.
Derfor, Jesus take en own blood make sakrifice, so dat en pipol go dey holy. So Jesus Christ sofa outside di kamp too.
Wen pesin don first know di trut; taste God gift from heaven; know di Holy Spirit;
Dis show how baptizim go save us, nor bi just to wosh dirty komot for pesin body, but na to show sey wi get good mind for God thru di way wey Jesus Christ take raiz-up
If wi gri sey wetin human being tok na true, den wetin God tok about en pikin, naim big pass.