5 Pesin wey bilive sey Jesus Christ na God Pikin, don win di world.
Den Jesus ask am, “Yu mean, ‘If I fit?’ Evritin dey possibol for di pesin wey bilive.”
Filip ansa, “If yu bilive, I go baptize yu.” Di man kon sey, “I bilive sey Jesus Christ na God Pikin.”
If anybody sey Jesus na God Pikin, dat show sey, God dey inside am and e dey inside God too.
Anybody wey bilive sey na Jesus bi Christ, don bi God pikin and anybody wey love di Papa, love di pikin wey E born.
Wi know sey God Pikin don kom and e don give us sense to know di trut about God. And wi dey inside en Pikin Jesus Christ. Na-im bi di real God and na-im bi di life wey nor go end.