I pray to God kon konfess all di bad tins wey wi don do sey: “God! Yu get pawa well-well and wi dey honor Yu. Yu dey keep yor promise and Yu love pipol wey love and dey obey Yu.
So make una undastand sey, di Oga una God na en really bi God. Na en bi di God wey dey keep en kovenant for tazon generashon kon dey show en love wey nor dey end to doz wey love and dey obey en kommand.
But naw, “Dis na my new kovenant (wey bi di new agriment): Di time dey kom wen I go put my laws for dia mout and rite am for dia heart. I go bi dia God and dem go bi my pipol.
(Na wetin love mean bi dis: make wi dey do wetin God wont.) Na di kommandment bi dis and just as wi hear am from di biginnin; na so wi suppose to follow am.