Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 John 5:20 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

20 Wi know sey God Pikin don kom and e don give us sense to know di trut about God. And wi dey inside en Pikin Jesus Christ. Na-im bi di real God and na-im bi di life wey nor go end.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 John 5:20
53 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

God wey dey rule and protet Israel pipol; di Pesin wey get pawa sey, “Na mi bi di First and di Last; e nor get any oda god apart from mi wey bi di Almighty God.


Bikos di Pesin wey kreate una, go bi una husband. Na God wey get pawa bi en name. Israel God wey dey holy go save una. Dem dey koll am di God of di whole eart.


Bikos dem don born one pikin for us! God don give us boy pikin! E go bi awa ruler and dem go koll am, “Wonderful Advise, Mighty God, Everlastin Fada and di Prince wey bring peace.”


But na only Yu Oga, bi di true God. Di God wey dey alive and Yu go rule forever. Anytime Yu dey vex, di world dey shake and nobody fit stand wen Yu dey vex.


Wen e bikom king, Judah pipol go dey save and Israel pipol go stay for peace. Dem go koll am, ‘Na God bi awa raitiousness.’ ”


Jesus ansa dem, “God don make una know all di sekret tins about en kingdom, but dis pipol nor know.


bikos I go give una di word wey una go tok and wisdom wey una enemy nor go fit oppoz.


Den e open dia mind so dat dem go fit undastand God word


Nobody don fit si God face before. But Jesus, wey bi God ensef, wey en and en Papa bi tait friend, na-im kom show us how God bi.


Dat time, una go know sey I dey inside my Papa and una dey inside mi, as I dey inside una.


Jesus ansa am, “Anybody wey love mi, go do wetin I tok and my Papa go love am, den wi go kon meet and stay with am.


Jesus ansa am, “Na mi bi di road, di trut and life. Nobody go fit go meet my Papa, unless e pass thru mi.


Jesus ansa am, “So Filip, I don dey with una all dis time and yu still nor know mi? Di pesin wey don si mi, don si my Papa! Why yu kon dey sey, ‘Show us yor Papa?’


Make una dey inside mi, so dat I go dey inside una too. As di branches nor fit bear fruit with en own pawa unless e dey inside di vine, na so una nor go fit bear fruit, unless una dey inside mi.


I don give dem yor word and bikos of dat, di pipol for world hate dem, since dem nor bilong to di world, as misef nor bilong to di world.


Holy Papa, even if di pipol for di world nor know yu, I know yu and dis ones know sey na yu send mi.


Life wey nor dey end, dis na wetin e mean, ‘Na make pipol know yu wey bi di only true God and Jesus Christ, wey yu send.’


Tomas ansa am, “O! My Oga God and my God.”


Den Jesus ansa, “If to sey na God bi una Papa, una for like mi, bikos I kom from God and as I dey so, I nor kom do my own tins, bikos na-im send mi.


Make una take kare of unasef and all di pipol wey di Holy Spirit don put under una, bikos na una bi di leaders for God church wey E buy with en only pikin blood.


Awa grand-grand papa dem wey follow God waka before, na from dem dis pipol from kom. So I dey pray make dem praiz God wey dey rule evritin forever and ever! Amen.


Una don bi Christ friends bikos of God and na thru Christ wi get wisdom, goodness and holiness wey kom from God;


Bikos God wey sey, “Make lite shine from darkness,” Na-im dey shine inside awa heart, so dat E go give us di lite wey show us en glory wey dey Christ face.


So, if any man dey inside Christ, e don dey new, Christ don klean di bad tins wey e do before and evritin don turn to new one!


una go fit join all God pipol undastand how God love wide, long, high and deep rish.


kon bi one with am. My raitiousness nor kom from di law, but I dey raitious thru my faith for Christ. Bikos na thru faith God take make us dey raitious with am.


Wi know sey God ways dey great well-well: Christ kom as human being; di Spirit show sey e dey free; angels si am wen e kom prish among Gentile pipol; pipol bilive am for di world and God karry am go heaven with glory.


bikos wi dey wait for di day wen God sey Christ, wey bi awa God Almighty and Savior, go kom.


but koncerning en pikin, E sey: “Yu bi God! Yor kingdom go dey forever and ever and yu go rule yor pipol with authority.


Anybody wey rijet di Pikin, nor get di Papa. But if pesin asept di Pikin, e don asept di Papa too.


As for una, wetin una don hear from di biginnin, make una let am stay inside una. If wetin una hear from di biginnin stay inside una, una go stay inside di Pikin and en Papa.


Di pesin wey sey en with God dey togeda forever, dat pesin suppose live en life as Christ live en own.


Wi don si with awa eye sey, di Papa send en Pikin to bi Savior for di world.


Wi know and bilive sey, God love us and en love dey inside us.


Dis na how una go take know God Spirit: If pesin bilive sey na Jesus bi di Mezaya, wey kom as human being, dat pesin get God Spirit.


Anybody wey bilive sey na Jesus bi Christ, don bi God pikin and anybody wey love di Papa, love di pikin wey E born.


And if wi know sey E dey hear us, den wi bilive sey wi go get di tins wey wi ask from am.


Wi know sey anybody wey bi God pikin, nor dey like to sin, but God dey keep en pikin, so dat devil nor go fit tosh am.


Pesin wey bilive sey Jesus Christ na God Pikin, don win di world.


Dem dey sing Moses wey bi God savant and di Lamb song sey: “God wey dey mighty, si as di tins wey yu dey do dey big and wonderful! Yu wey bi king for all nashons. Yu nor dey do parsha and evritin wey yu dey do, na true.


Den I si heaven open and one white horse dey kom out! Dem dey koll di Pesin wey dey ride di horse, “Faithfulnes and Trut.” E dey judge without parsha or wayo even as E dey go fight war.


“Make yu rite di tins wey I won tell yu naw, go give di angel for di church wey dey Laodicea: ‘Dis message na from di Pesin wey bi di Amen; di witness wey dey obey God kommandment since E kreate di world.


“Make yu rite di tins wey I won tell yu naw, go give di angel for di church wey dey Filadelfia: ‘Di Pesin wey dey holy and true, wey whole David key; wen dis pesin open door, nobody go fit klose am and wen e klose door, nobody go fit open am.


Dem dey kry with loud vois sey, “Oga God wey get pawa, how long e go take before yu go judge doz wey dey live for dis eart? Make yu ponish dem, bikos na dem kill us!”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ