2 Wi go know sey wi love God shidren, wen wi love God and obey en kommandment.
Wetin I dey tell una bi sey, ‘Make una love each oda.’ ”
Wen wi do wetin God sey make wi do, den wi go dey sure sey wi know am.
But anybody wey do wetin dem rite for God word, true-true, God word really dey inside am. Na dis go make us know sey wi dey inside God.
Wi know sey wi don cross from deat enter life, bikos wi dey love and kare for awa brodas and sistas for Christ.
God don kommand us sey: “If anybody love mi, make e love en broda and sista for Christ too.”