I dey with dem and yu dey with mi, so dat dem go really bi one, just as wi bi one and di world go know sey na yu send mi and yu love dem, as yu love mi.
Una still dey sey, “Food dey good for awa body and awa body nid food.” But I dey tell una, “God go distroy di two of dem.” So make wi nor use awa body take do yeye tins.
bikos doz wey nor bilive, di gods for dis time don blind dia mind, so dem nor go si lite wey dey dis gospel wey get glory and dis gospel na Christ wey bi God image.
Wish kind business God Temple and juju get? Bikos wi bi God Temple, just as God sey, “I go stay inside dem and waka among dem, den, I go bi dia God and dem go bi my pipol.”
(My shidren, I dey rite about dis matter, so dat una nor go dey sin.) But if anybody sin, wi get pesin wey dey beg di Papa for us, dat pesin, na Jesus Christ wey dey raitious
I dey rite give una wey bi papa, bikos una know di pesin wey dey alive since God kreate di world. I dey rite give una wey bi yong pipol, bikos una don win Satan.
So anybody wey do all wetin God tok, dey inside am and God dey inside dat pesin too. Wi know sey E dey inside us, bikos di Spirit wey E give us, dey stay inside us.
Wi kom from God and di pesin wey know God dey listin to us, but pesin wey nor know God, nor dey gri with us. Dis na how wi take dey know di thru Spirit and di spirit wey dey deceive pipol.