20 If somebody sey, “I love God” and e hate en Christian broda, e dey lie, bikos pesin wey nor love en Christian broda wey e dey si, how e wont take love God wey e nor dey si?
so dat evribody go know sey, una bi my disciples if una love each oda.”
Aldo una neva si am, but una love am. Una nor dey si am naw, but una bilive am, una get happiness and glory wey una nor go fit esplain.
If wi sey wi bi en friend and wi still dey inside darkness, wi dey lie and trut nor dey awa mout.
If wi sey wi nor get sin, wi dey deceive awasef and di trut nor dey inside us.
But di one wey hate en broda or sista for Christ, dey for darkness and e nor know where e dey go, bikos darkness don blind en eye.
Di pesin wey sey, “I know God” and e nor dey do wetin God tok, dat pesin dey lie and di trut nor dey inside am.
Pesin wey sey e dey inside di lite, but e still hate en broda or sista for Christ, dat pesin still dey inside darkness.
But pesin wey get enough tins and e nor sorry for en broda or sista for Christ wey nor get at-all, na how God love go take dey inside am?
Nobody don ever si God before. If wi love each oda, God dey inside us and en love dey pafet inside us.