13 God don give us en Spirit to show sey wi dey inside am and e dey inside us.
God give us en Spirit, so wi nor dey tink as dis world pipol dey tink and naim make us know di blessings wey God don give us.
Abi una nor know sey una body na di temple wey di Holy Spirit dey stay? So, nor bi una get unasef.
Wen wi do wetin God sey make wi do, den wi go dey sure sey wi know am.
But anybody wey do wetin dem rite for God word, true-true, God word really dey inside am. Na dis go make us know sey wi dey inside God.
So anybody wey do all wetin God tok, dey inside am and God dey inside dat pesin too. Wi know sey E dey inside us, bikos di Spirit wey E give us, dey stay inside us.