So I go tok with am face-to-face and nor bi with word wey e nor go undastand and e go si as God bi. So wetin make una nor dey fear to tok against my savant Moses?”
Dis God nor fit die and E dey stay for lite wey nobody fit waka near. Lite wey human being neva fit si. Make all honor and pawa bi en own forever and ever. Amen!
So anybody wey do all wetin God tok, dey inside am and God dey inside dat pesin too. Wi know sey E dey inside us, bikos di Spirit wey E give us, dey stay inside us.
If somebody sey, “I love God” and e hate en Christian broda, e dey lie, bikos pesin wey nor love en Christian broda wey e dey si, how e wont take love God wey e nor dey si?
Wi kom from God and di pesin wey know God dey listin to us, but pesin wey nor know God, nor dey gri with us. Dis na how wi take dey know di thru Spirit and di spirit wey dey deceive pipol.