10 Na dis bi love: nor bi sey wi first love God, but na-im first love us wen E send en Pikin kom die for us as sakrifice wey make am forgive us awa sins.
“God don set seventy weeks as di time wen E go take free yor pipol kon ribuild en temple. Una dey sofa, bikos of all di evil and wiked tins wey una do. Afta, E go forgive una sins and judge una well forever, so dat wetin E tok, go happen. Den E go anoint di holy temple again.
Nor bi una choose mi, but na mi choose una. Bikos of dat, I don give una pawa to bear fruit wey go last, so dat my papa go give una anytin wey una ask am for my name.
“God love di pipol wey dey dis world well-well, so E kon send di only pikin wey E get to us, so dat anybody wey bilive am, nor go die, but e go get life wey nor dey end.
Na mi bi di bread wey kom down from heaven. Anybody wey chop dis bread go live forever. Na my flesh bi di bread wey I go give di pipol wey dey for dis world.”
So God make Christ like us wey bi en brodas and sistas. Like dis, Christ go sorry for us kon bi awa good High Priest. And bikos Christ dey koncern about God matter, e sakrifice ensef to remove awa sins.
Make una si di kind love wey awa God get for us. And naw, pipol dey koll us God shidren and true-true, na God shidren wi bi. Di world nor know us, bikos dem nor know am.