Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 John 3:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Evribody wey dey like to sin, nor dey obey God law and to sin, na to disobey God law.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 John 3:4
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

make Yu still listin to yor pipol prayer. If dem turn kom meet Yu for dat land kon pray and konfess dia sin and di wiked tins wey dem don do, my Oga God, make Yu hear dia prayers.


Saul die bikos e nor respet or obey God kommand. E go meet spirit make e help am


God Spirit kon enter Zekaraya wey bi Jehoiada pikin. E stand up kon tell di pipol, “Dis na wetin God tok: ‘Why una nor dey obey God kommand? Una nor go prosper and God don rijet una, bikos una nor gri obey am!’ ”


Dem arrest and sey make dem kill-am and nobody kare about am. Dem kill-am, bikos of awa sins.


“All of us don break yor law and wi nor gri listin to wetin Yu tok. Wi don sin and na awa sins make Yu dey ponish us so, just as yor savant, Moses rite am for di law.


bikos e nor gri do wetin God tok or obey en kommand. Na en use en hand kill ensef.’ ”


So anybody wey nor do wetin God kommand and dey tish odas to do as e dey do, naim go small pass for God Kingdom. But pesin wey obey God and tish odas to do wetin di Law tok, na big pesin e go bi for God Kingdom.


So Paul tell am, “God go slap yu too, yu wey dey pritend! Yu sidan dey judge mi with di law, yu nor dey disobey di law wen yu sey make dem slap mi?”


Nobody dey good for God eye, bikos e dey obey di law. But na thru di law, wi take know wetin sin mean.


Di law dey bring God vexnashon, bikos where sin nor dey, law nor go dey.


I dey fear sey wen I kom again, God go disgrace mi for una front. And I go kry, bikos many of una still dey sin. Una neva turn from sin kom meet God; una neva turn komot from di ashawo and yeye life wey una dey live.


Di prayer wey dem take faith pray go save di pesin wey nor well and God go make am well. And if e kommit any sin, God go forgi-am.


Evritin wey nor good for God eye, na sin, but e get di sins wey nor dey kause deat.


Den Saul kon tell Samuel, “I don sin, bikos I nor obey God kommand and wetin yu tok. Bikos I dey fear di sojas, I kon follow wetin dem tok.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ