Anytin wey yu bilive about dis matter, make yu keep am to yorsef and God wey dey heaven, dey si am. God don bless di pesin wey nor kondemn ensef, bikos of wetin e do.
Wi dey happy, bikos wi know sey di way wi dey live awa life for dis world and how wi dey bihave with una, dey show sey na God send us thru en pawa, nor bi human being own.
Una wey bi my friends, I nor dey rite new kommandment give una, na di old one wey una get from di biginnin, I still dey rite and una don hear dem before.
My friends, wi bi God shidren naw and wi neva know as wi go bi wen Christ go kom back. But wi know sey wi go bi like am, bikos wi go si am just as E bi.
And as wi dey stay inside God, awa love dey grow more-more. So wi nor go fear for judgement day, but wi go face God with konfident, bikos wi live like Jesus Christ wen wi dey di world.