Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 John 3:20 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

20 So, even if awa mind kondemn us, wi know sey God big pass awa mind and E know evritin.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 John 3:20
23 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I nor go ever give up, bikos I dey rite; my mind dey klean and my konscience nor dey judge mi.


But I won tell yu sey yu dey wrong, bikos God big pass evribody.


Yu know all di sins wey wi kommit; even di sins wey wi hide do, Yu dey si all of dem.


Na mi wey bi God dey si and test human being heart. I dey trit each pesin akordin to how e dey live en life and wetin e dey do.


E nor get where pesin go hide put make I for nor si am. Yu nor know sey I dey evriwhere for di heavens and di eart?


Jesus ask am di third time, “Simon, John pikin, yu sure sey yu love mi so?” Pita kon dey vex, bikos e pain am well-well, as Jesus ask am di same kweshon three times, “Yu sure sey yu love mi so?” Den Pita sey, “Oga God, yu know evritin, yu know sey I really love yu.” So, Jesus tell am, “Make yu feed my sheep.


Wen dem hear wetin e tok, dem kon dey komot for der one-by-one. Na di old pipol first start to komot, till e remain only Jesus and di woman wey stand for en front.


Wen di priest oga dem hear dis tin, dem kon vex well-well and won kill di apostles.


Who bi di pesin wey go kondemn us? Na Jesus Christ wey die for us; di pesin wey God raiz from deat and naw, e dey for God rite hand side dey pray for us.


My mind dey klear, but dat nor mean sey I dey innocent. Na only God go fit judge mi.


Bikos dat kind pesin don turn from di trut and en own sin go kondemn am.


Nor-tin wey God kreate fit hide from am and evritin dey naked to God, bikos wi go must tell am how wi live awa life.


Nobody big pass God, bikos God swear with en name wen E promise Abraham sey,


Wetin wi dey do go show sey wi dey live for di trut, so wi go dey bold wen wi stand for God present.


My friends, if awa mind nor kondemn us, awa heart go strong for God present


My shidren, una kom from God and una don get viktory ova doz pipol, bikos di pesin wey dey inside una, big pass di pesin wey dey di world.


I go kill all en shidren, den all di church pipol go know sey, I know wetin dey for pipol mind and heart. I go reward evribody akordin to wetin e do.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ