Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 John 3:17 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

17 But pesin wey get enough tins and e nor sorry for en broda or sista for Christ wey nor get at-all, na how God love go take dey inside am?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 John 3:17
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Raitious pipol dey kare for dia animals, but wiked pipol dey trit dia own anyhow.


Doz wey dey opress poor pipol, dey kause God wey kreate dem, but to help poor pipol, na to honor God.


Wen yu give sometin to poor pipol, e bi like sey God dey borrow from yu and God go pay yu evritin wey E borrow.


If yu nor gri listin to poor pipol kry, dem nor go hear yor own kry for help.


If yu nor dey obey di law, God nor go hear yor prayers.


John ansa dem, “Di pesin wey get two klot must give one to pesin wey nor get at-all and di pesin wey get food must share with pesin wey nor get.”


Una know di grace wey awa Oga God Jesus Christ get; even doh e dey rish, e kon turn poor man bikos of una, so dat thru en poverty, una go dey rish.


Make una nor forget to do good and to share wetin una get with each oda, bikos doz kind sakrifice, dey make belle sweet God.


If one broda or sista nor get klot to wear or food to chop


and one pesin among una tell am, “Make peace dey with yu; make kold nor katch yu and make yu go chop beleful, but yu nor gi-am wetin di body wont, na wish kind good bi dat?”


If somebody sey, “I love God” and e hate en Christian broda, e dey lie, bikos pesin wey nor love en Christian broda wey e dey si, how e wont take love God wey e nor dey si?


Anybody wey bilive sey na Jesus bi Christ, don bi God pikin and anybody wey love di Papa, love di pikin wey E born.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ