Adam sleep with en wife again and e get belle kon born boy, den Eve koll am Seth, bikos e sey, “God don give mi anoda pikin wey go take Abel place. Abel wey Kain kill.”
So all God pipol blood wey una kill for dis world, go dey una head. From Abel blood go rish Zekaraya wey bi Barakaya pikin, wey una kill for inside di temple.
E get any profet wey una grand-grand papa dem nor kill? Dem even kill di messenja wey tok before sey, ‘Di Raitious Man go kom and una go gi-am to wiked pipol and dem go kill-am.’
My brodas and sistas, na di same tin happen to God church for Judea and una wey bilive Christ for der don still sofa pain from una kountry-men wey bi Jew pipol.
Na faith make Abel give God sakrifice wey betta pass Kain own and na thru dis faith Abel take know sey God asept en ofrin, bikos God really asept am. Even doh Abel don die, en blood still dey tok for am, bikos of en faith.
Una don kom meet Jesus, di pesin wey God use take start di new kovenant with en pipol and una don kom meet di blood wey dem spray and dis blood dey tok betta word wey pass Abel own.
But pesin wey dey like to sin, na devil pikin, bikos devil dey sin from di biginnin. Na dis one make God Pikin kom dis world, so dat e go skata all di work wey devil dey do.
Curse dey dia head! Bikos dem dey bihave like Kain and bikos of long-trot, dem dey do di mistake wey Balaam do. So dem go must die like Korah, wey disobey God.
God pipol wey dem kill and doz wey prish about Christ, I si di woman wen e dey drink dia blood and di blood dey shark am like wine. I sopraiz well-well wen I si di woman.