11 Dis na di Good News wey una don hear from di biginnin sey, “Make wi love each oda as awasef.”
e kon stand up for where dem dey chop, remove en big koat kon tie towel for en waist.
Dis na di kommand wey I give una sey, ‘Make una love each oda di way I love una.’
Make una help karry each oda load and if una do like dis, una dey obey Christ.
Make wi love one anoda, just as Christ love and sakrifice ensef as ofrin wey get betta smell to God, bikos of us.
No nid to rite give una about love for una fellow Christians, bikos God ensef don tish una about how una suppose love each oda.
But di rizin why I dey give dis kommand, na bikos I love dem from my heart with betta mind and faith.
Una don klean una soul with di trut wey una dey obey and as brodas and sistas, make una love each oda well-well.
So, make una live for peace togeda, dey sorry for each oda; love one anoda and nor dey karry body up.
As una dey do so, make una love for each oda dey strong, bikos love dey kover plenty sins.
Na di message wey wi hear from am, naim wi dey tell una so: Na God bi lite and darkness nor dey inside am at-all.
My friends, if God love us like dis, den wi must love each oda.
God don kommand us sey: “If anybody love mi, make e love en broda and sista for Christ too.”
My friends, make wi love one anoda, bikos love kom from God and anybody wey love odas, na God pikin and e know God,
I dey rite to remind una sey, make una love one anoda. Dis nor bi new kommandment, but na di one wey dey from di biginnin.