10 Na like dis una go take know God and devil shidren. Pesin wey nor dey do wetin good for God eye and nor love en broda or sista for Christ, nor bi God pikin.
But make una love una enemies kon do good and make una nor espect anytin back wen una borrow anybody sometin. Na dis go make God pay una back and una go bi en shidren, bikos God ensef dey do good for wiked pipol and doz wey nor dey sey tank yu.
Na devil bi una papa and na di tin wey una papa wont, naim una dey do. E dey kill pipol from di biginnin and e nor dey support wetin good, as e nor get any good tin inside am. Anytime e dey tok, na di lie wey dey inside am, na-im e dey tok, e bi lie-lie pesin, bikos naim bi lie-lie papa.
Di pesin wey bi God pikin, dey listin and do wetin dem rite for God word. Una nor dey listin and una nor dey do wetin dem rite for God word, bikos una nor bi God Pikin.”
Make una si di kind love wey awa God get for us. And naw, pipol dey koll us God shidren and true-true, na God shidren wi bi. Di world nor know us, bikos dem nor know am.
My friends, wi bi God shidren naw and wi neva know as wi go bi wen Christ go kom back. But wi know sey wi go bi like am, bikos wi go si am just as E bi.
Wi kom from God and di pesin wey know God dey listin to us, but pesin wey nor know God, nor dey gri with us. Dis na how wi take dey know di thru Spirit and di spirit wey dey deceive pipol.