Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 John 2:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 Di pesin wey sey en with God dey togeda forever, dat pesin suppose live en life as Christ live en own.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 John 2:6
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Raitiousness dey go for God front go prepare di way wey E go pass.


Make una follow mi and learn from mi, bikos I gentol, I nor dey karry body up and I go give una peace for una mind.


I don give una ezample wey una go follow. So make una do for each oda as I don do for una.


If una do wetin I tok, I go love una, just as I dey obey wetin my Papa tok and E love mi.


Make wi love one anoda, just as Christ love and sakrifice ensef as ofrin wey get betta smell to God, bikos of us.


bikos na wetin E koll yu to do, bi dat. Christ sofa as ezample wey una go follow


Naw my shidren, make una stay inside am, so dat wen E kom, awa heart go dey strong well-well and shame nor go make us run from where E dey.


Di pesin wey sey, “I know God” and e nor dey do wetin God tok, dat pesin dey lie and di trut nor dey inside am.


So anybody wey do all wetin God tok, dey inside am and God dey inside dat pesin too. Wi know sey E dey inside us, bikos di Spirit wey E give us, dey stay inside us.


Anybody wey dey stay inside am nor dey like to sin, but pesin wey dey kommit sin, neva si or know am.


And as wi dey stay inside God, awa love dey grow more-more. So wi nor go fear for judgement day, but wi go face God with konfident, bikos wi live like Jesus Christ wen wi dey di world.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ