Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 John 2:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Wen wi do wetin God sey make wi do, den wi go dey sure sey wi know am.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 John 2:3
26 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I go run follow yor kommands, bikos Yu dey make mi undastand life well-well.


den I nor go shame, bikos I dey follow wetin Yu tok.


But wen e si all di good tins wey en sofa bring, belle go sweet am. My savant wey I like well-well, go bear plenty pipol ponishment and I go forgive dem bikos of am.


“Why una dey koll mi, ‘Oga God’ and una nor dey do wetin I tell una?


“If una love mi, una go do wetin I tok.


If una do wetin I tok, I go love una, just as I dey obey wetin my Papa tok and E love mi.


Una go bi my friend if una do wetin I tok.


Life wey nor dey end, dis na wetin e mean, ‘Na make pipol know yu wey bi di only true God and Jesus Christ, wey yu send.’


Bikos God wey sey, “Make lite shine from darkness,” Na-im dey shine inside awa heart, so dat E go give us di lite wey show us en glory wey dey Christ face.


Wen God don make Christ pafet finish, e kon save evribody wey obey am.


I dey rite give una wey bi papa, bikos una know di pesin wey dey alive since God kreate di world. I dey rite give una wey bi yong pipol, bikos una don win Satan.


Wi know sey wi don cross from deat enter life, bikos wi dey love and kare for awa brodas and sistas for Christ.


Wetin wi dey do go show sey wi dey live for di trut, so wi go dey bold wen wi stand for God present.


Anybody wey dey stay inside am nor dey like to sin, but pesin wey dey kommit sin, neva si or know am.


God don give us en Spirit to show sey wi dey inside am and e dey inside us.


My friends, make wi love one anoda, bikos love kom from God and anybody wey love odas, na God pikin and e know God,


Wi know sey wi bi God shidren and dis world wey wi dey so, na wiked pipol dey rule am.


Wi go know sey wi love God shidren, wen wi love God and obey en kommandment.


To love God, na to keep en kommandment and en kommandment nor dey hard.


Di dragon dey vex for di woman, so e kon decide to fight all di shidren wey di woman born, dat is, evribody wey keep God kommandment and bilive Jesus Christ.


Dis mean sey, God pipol go bear well-well, bikos dem dey obey en kommandment and get faith for Christ.


God don bless doz wey wosh dia klot klean, so dem go get authority to chop from di tree wey dey give life and dem go fit pass di gate enter di town.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ