Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 John 2:25 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

25 Dis na di promise wey Christ ensef promise us sey, di life wey e go give, nor go ever end.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 John 2:25
25 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Many pipol wey don die go raiz; doz wey dey holy go get life wey nor dey end, while odas go sofa forever.


God go bless am with wetin pass all di tins wey e leave, both for dis world and for di life wey dey kom.”


I don give dem life wey nor dey end and dem nor go ever die. Nobody go fit take dem komot from my hand.


I know sey anytin wey God kommand, dey give life wey nor dey end, so I dey tok wetin E send mi.”


so dat anybody wey bilive am, go get life wey nor dey end.


Una dey read God word well-well, bikos una bilive sey na wetin una read, go give una life wey nor dey end and na dis same word dey tok about mi,


Make una nor work for food wey nor dey last, but for food wey go give una life wey nor dey end and dat kind food, na only Man Pikin go fit give una, bikos na-im God send kom.”


Wetin my Papa wont bi sey, anybody wey bilive en pikin, go get life wey nor dey end and I go wake am up for di last day.”


I dey tell una true word, anybody wey bilive mi, don get life wey nor dey end.


Di pesin wey go chop my flesh and drink my blood, don get life wey nor dey end and I go take am up for di last day.


Den Simon Pita ansa am, “Oga God, na who wi go kon go meet? Na yu get di word wey dey give pipol di life wey nor dey end.


God go give life wey nor dey end to di pipol wey dey do good, wey wont glory, honor and long life.


and as sin dey kontrol us thru deat, na so God grace dey rule thru raitiousness wey dey bring life wey nor dey end bikos of Jesus Christ wey bi awa Oga God.


Bikos, di reward for sin, na deat, but God gift wey Jesus Christ dey give us, na life wey nor dey end.


bikos di pesin wey dey live akordin to en flesh, go reap bad tins, but di pesin wey dey live akordin to God Spirit, go reap life wey nor dey end.


But God sorry for mi, so dat Christ go use mi as betta ezample to show sey, e dey patient with even di pesin wey sin pass. Den odas go know sey, demsef go fit bilive am kon get life wey nor dey end.


Make yu fight di fight wey dey make faith strong and whole di life wey nor dey end, wey go make pipol praiz God, bikos na dis make am koll yu.


If dem dey do like dis, dem go dey use dia money and propaty take lay good foundashon for dia future, so dat dem go get life wey nor dey end.


Di trut dey give dem di mind sey dem get life wey nor dey end and na God wey nor fit lie promise dem dis life even before E kreate di world.


Since Christ grace don make us klean for God eye, wi don bi pipol wey dey wait for di life wey nor go end and wi dey sure sey, wi go get am.


and dis life kom out and wi don si am. Na dis tins wi dey tok about. Wi dey tell una about di life wey nor dey end, wey dey with di Papa for heaven and E don show am to us.


Wi know sey God Pikin don kom and e don give us sense to know di trut about God. And wi dey inside en Pikin Jesus Christ. Na-im bi di real God and na-im bi di life wey nor go end.


Make una keep unasef inside God love as una dey wait for awa Oga God Jesus Christ, wey go bring life wey nor go end.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ