Na devil bi una papa and na di tin wey una papa wont, naim una dey do. E dey kill pipol from di biginnin and e nor dey support wetin good, as e nor get any good tin inside am. Anytime e dey tok, na di lie wey dey inside am, na-im e dey tok, e bi lie-lie pesin, bikos naim bi lie-lie papa.
My shidren, di world don dey end and just as una hear sey, anti-Christ dey kom, make una know sey many anti-Christ don already kom. And dis show us sey di world go soon end.
If somebody sey, “I love God” and e hate en Christian broda, e dey lie, bikos pesin wey nor love en Christian broda wey e dey si, how e wont take love God wey e nor dey si?
But evribody wey nor gri sey Jesus na Oga God, dat pesin spirit nor kom from God. Dat na di anti-Christ spirit wey una hear sey dey kom and e don already dey dis world.
Bikos pipol wey dey deceive odas, don enter di world; dem nor gri sey Jesus Christ don kom dis world as human being before. Dis kind pipol dey deceive odas and na anti-Christ dem bi!
Some pipol don hide join una and God don mark dem for distroshon. So I won tell una about dis tins sey, dis pipol nor dey fear God. Dem don dey use God grace as eskuse to dey do bad-bad tins. Dis pipol nor gri asept Christ as dia Masta and Oga God.