Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 John 2:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 and na en ensef bi di sakrifice wey God nid to forgive us awa sins. Nor bi only awa sin, but di sin wey di whole world dey kommit.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 John 2:2
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dem go give di life goat wey dem choose for Azazel to God kon send am komot go Azazel for di wildaness, so dat God go forgive di pipol dia sin.


“Afta, di savant sey, ‘Oga God, I don do wetin yu tok and di party neva still full.’


Wen day break, John si Jesus dey waka kom meet am, den John sey, “Make una look! Dis na di Sheep wey God send kom die, so dat God go forgive us awa sins.”


But as for mi, if una karry mi go up for cross, I go draw evribody kom meet mi.”


Den dem kon tell di woman, “Nor bi wetin yu tell us make us bilive, but bikos wi don take awa own ear hear and wi don know sey, dis pesin true-true, na-im go save all di pipol wey dey dis world.”


So God make Christ like us wey bi en brodas and sistas. Like dis, Christ go sorry for us kon bi awa good High Priest. And bikos Christ dey koncern about God matter, e sakrifice ensef to remove awa sins.


E karry awa sin for cross, so dat wi go stop to sin and dey do good for God eye. “Na di wound wey dem wound am, naim make us well.”


Bikos of sin, Christ sofa. En wey nor do bad, sofa for doz wey do bad, so dat e go karry us go meet God. And wen dem kill-am, e wake-up as spirit.


But if wi dey inside di lite as en ensef dey inside lite, all of us go bi en friend and Jesus wey bi en pikin, go use en blood take wosh all awa sins komot.


And una know sey God send Jesus kom, make e for karry sin komot and know sin dey inside Christ.


Na dis bi love: nor bi sey wi first love God, but na-im first love us wen E send en Pikin kom die for us as sakrifice wey make am forgive us awa sins.


Wi don si with awa eye sey, di Papa send en Pikin to bi Savior for di world.


Wi know sey wi bi God shidren and dis world wey wi dey so, na wiked pipol dey rule am.


Dis dragon na di old snake wey bi di devil or Satan, wey dey deceive di world. Dem trow am kom down from heaven with en angels.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ