Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 John 2:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 I dey rite give una wey bi papa, bikos una know di pesin wey dey alive since God kreate di world. I dey rite give una wey bi yong pipol, bikos una don win Satan.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 John 2:13
36 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

yong men and yong wimen; old men and shidren, make all of dem praiz God.


Yu bi God wey nor dey die! Even before Yu kreate di mountins and di whole world, Yu don dey.


God sey, “I go save pipol wey love mi. I go protet doz wey trust my name.


Yong pipol glory dey dia strent; so make una respet di white hair wey old pipol get.


Afta all dis tins, I go put my spirit for una body. Una shidren go prish my message; di old pipol among una go dey dream dreams, while di yong ones go dey si vishon.


Dem go dey good and fine well-well! Di korn and wine wey di yong pipol go dey chop and drink, go make dem grow and dey strong.


“My Papa put evritin for my hand. Nobody know di pikin, but na only en Papa know am. Nobody know di Papa, but na only di pikin and anybody wey di pikin choose to show.


‘Wen pesin hear God word and e nor undastand am, di devil go kom tif di word wey dem plant for en heart, dis na di seed wey fall for road.


di farm na di world and di good seed na di kingdom pipol. Di grass na devil shidren


Wen yu sey, ‘Yes,’ make yu mean am and wen yu sey ‘No,’ make yu mean am too. Any oda tin wey yu tok pass dis, na devil e from kom.”


“My Papa don give mi evritin. Nobody know who di pikin bi escept di Papa and nobody know who di Papa bi escept di pikin and pipol wey di pikin choose to show.”


But since una don know mi, una go know my Papa too. Naw wey una don know am, una don si am.”


Jesus ansa am, “So Filip, I don dey with una all dis time and yu still nor know mi? Di pesin wey don si mi, don si my Papa! Why yu kon dey sey, ‘Show us yor Papa?’


Dem go do all dis tins, bikos dem nor know mi and my Papa.


“I don tell una all dis tins, so dat my peace go stay with una. Wahala full inside di world and sofa dey too, but make una heart dey strong, bikos I don already win di world.”


Papa, I dey pray, so dat all of dem go get one mind, just as mi and yu bi one. I still dey pray make dem dey with us, so dat di world go bilive sey na yu send mi.


Life wey nor dey end, dis na wetin e mean, ‘Na make pipol know yu wey bi di only true God and Jesus Christ, wey yu send.’


Dem kon bigin kweshon am, “Who bi yor Papa sef?” Jesus ansa dem, “Una nor know mi or my Papa, if to sey una know mi, una for know my Papa too.”


Bikos God wey sey, “Make lite shine from darkness,” Na-im dey shine inside awa heart, so dat E go give us di lite wey show us en glory wey dey Christ face.


Make yu nor tok anyhow to pesin wey old pass yu, but dey tok to am with respet like sey yu dey tok to yor papa. Tok to yong men as yu go take tok to yor broda.


Make yu tish yong men to dey live dia life with betta sense


Di tin wey dey from di biginnin, wey wi don hear and si with awa eye; wey awa hand don tosh (tins wey koncern di word wey dey give life


(My shidren, I dey rite about dis matter, so dat una nor go dey sin.) But if anybody sin, wi get pesin wey dey beg di Papa for us, dat pesin, na Jesus Christ wey dey raitious


My shidren, I dey rite give una sey God don forgive una sins, bikos of Jesus name.


I don rite give una, my shidren, bikos una don know God. I don rite give una wey bi papa, bikos una don know di pesin wey dey alive since God kreate di world. I don rite give una yong pipol, bikos una dey strong and God word dey inside una, as una don win Satan.


Nor bi like Kain wey bi devil pikin, wey kill en broda. And wetin make am kill-am? Na bikos God nor asept en ofrin as E asept Abel own.


My shidren, una kom from God and una don get viktory ova doz pipol, bikos di pesin wey dey inside una, big pass di pesin wey dey di world.


Wi know sey anybody wey bi God pikin, nor dey like to sin, but God dey keep en pikin, so dat devil nor go fit tosh am.


Wi know sey God Pikin don kom and e don give us sense to know di trut about God. And wi dey inside en Pikin Jesus Christ. Na-im bi di real God and na-im bi di life wey nor go end.


God pipol don win Satan with di Lamb blood and with di word wey dem tok about Christ. Dem nor too kare for dia life, so dem even dey ready to die.


Pesin wey get ear, make e hear wetin di Spirit dey tell di pipol for di church. Anybody wey fit bear rish di end, I go allow am chop from di tree for God Paradise and dis tree dey give life.’ ”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ