Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 John 2:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 My shidren, I dey rite give una sey God don forgive una sins, bikos of Jesus name.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 John 2:12
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But God still save dem, just to defend di honor for en name and to show en mighty pawa.


My God, bikos of di honor wey yor name get, make Yu forgive mi my many-many sins.


Den I ansa, “My God, even doh awa sins dey tok against us, make Yu kom save us bikos of di honor for yor name. True-true, wi don turn from Yu many times and sin against Yu.


and dem go use en name prish give pipol make dem for turn from dia sin kom meet God and di prishin go start from Jerusalem.’


Wen Jesus si how dia faith big rish, e kon tell di man, “My friend, I forgive yu all yor sins.”


All di profets tok about am sey, ‘Evribody wey bilive am, thru en name, God go forgive dem.’ ”


So my pipol, make una know sey, na thru dis Pesin wi dey prish sey, ‘God go forgive una.’


And na en pawa God dey use save pipol, bikos for di whole world, e nor get any oda name wey get pawa to save pipol, like Jesus Christ own.”


Na so some among una bi before, but naw, God don wosh una klean thru Jesus Christ name and en Spirit pawa, don make una klean for en eye.


Na thru Christ blood wi take get salvashon and na dis blood make God dey forgive us awa sins, bikos en grace big well-well.


Make una dey good to one anoda; dey sorry for pipol and dey forgive each oda, just as God forgive una thru Christ.


Dis na di pikin wey pay for us, so dat wi go dey free and God go forgive us awa sins.


Na dis make us dey rite dis leta, so dat awa joy go full well-well.


But if wi dey inside di lite as en ensef dey inside lite, all of us go bi en friend and Jesus wey bi en pikin, go use en blood take wosh all awa sins komot.


But if wi konfess awa sin to am, e go forgive us kon wosh evritin wey nor good for God eye komot from awa life, bikos Christ dey always do wetin e sey e go do, since e dey raitious.


(My shidren, I dey rite about dis matter, so dat una nor go dey sin.) But if anybody sin, wi get pesin wey dey beg di Papa for us, dat pesin, na Jesus Christ wey dey raitious


I nor rite give una, bikos una nor know di trut, but na bikos una know Christ and di trut dey stay inside am.


Una wey bi my friends, I nor dey rite new kommandment give una, na di old one wey una get from di biginnin, I still dey rite and una don hear dem before.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ