10 Pesin wey love en broda or sista for Christ, dey live inside di lite and nor-tin go make am fall.
Pipol wey love wetin Yu tok, get peace of mind and dem nor dey fear, shake or fall.
So make wi serve God. As far day dey break and rain dey fall for di eart, E go kom save us.
but di seed nor get rut, bikos di word wey e hear, nor strong for en heart, so wen trobol kom, e nor go fit bear-am.
“Wahala dey for dis world, bikos of di sin wey pipol dey kommit! Na true sey trobol must kom, but e go bad for di pesin wey go kause di trobol.
Jesus ansa, “Evriday get twelf hours wey lite dey take shine, so pipol nor dey fear to waka, bikos dem dey si well-well, as e bi sey lite dey.
Jesus ansa dem, “My lite nor go dey with una tey. Naw wen di lite dey, make una take am waka, so dat darkness nor go kover una. Bikos di pesin wey dey waka for darkness, nor dey si where e dey go.
Jesus kon tell di pipol wey kom from Judea wey bilive am, “If una obey wetin I dey tish una, den una go bi my disciples
So, make wi nor dey judge one anoda and make wi nor spoil anoda pesin faith.
so dat una go fit choose wetin betta pass and as una dey do so, una go dey ready for di day wen Christ go kom.
So my brodas and sistas, make una do evritin to show sey, God koll and choose una. As una dey do so, una nor go ever fall inside sin.
But di one wey hate en broda or sista for Christ, dey for darkness and e nor know where e dey go, bikos darkness don blind en eye.
Wi know sey wi don cross from deat enter life, bikos wi dey love and kare for awa brodas and sistas for Christ.