Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 John 1:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Di tin wey dey from di biginnin, wey wi don hear and si with awa eye; wey awa hand don tosh (tins wey koncern di word wey dey give life

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 John 1:1
23 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So, na who do all dis tins? Na who tok how generashon go bi? Na mi wey bi God; na mi bi First and na mi bi Last.


But yu, Betlehem Efrat yu bi one small town for Judah. But na from yu di pesin wey go rule Israel go from kom and en family dey among Israel pipol since.


as di pipol wey si dem wen dem happen, tell us.


Make una look my hand and leg and make una tosh mi: spirit nor get flesh and bone as una si sey I get.”


All dis story na true, (bikos na di pesin wey si dem happen, naim tok about dem and wetin e tok na true), so dat una go fit bilive.


Den e tell Tomas, “Put yor finger for my hand, make yu tosh am. Stresh yor hand put inside di korna for my belle. Make yu nor dey doubt again, but make yu bilive.”


Bikos as di Papa get life for inside am, na so e give en pikin life too.


Jesus ansa dem, “Na true word I dey tell una so, before dem born Abraham, I don already dey!”


Na di same apostles e show ensef many time sey, e still dey alive afta di sofa wey e sofa. Dem si am for forty days and e tell dem about God kingdom.


bikos wi nor go fit sey make wi nor tok about wetin wi don si and hear.”


Wetin make us sey wi go dey free if wi nor listin to dis korrect salvashon message? Na God first tok am and pipol wey hear am kon show us sey na trut.


Wi don si with awa eye sey, di Papa send en Pikin to bi Savior for di world.


Wi get three witness to show sey wetin wi dey tok, na true and dem bi:


“Make yu rite evritin wey yu dey si inside dis book, den send dem go meet di pipol wey dey di seven church wey dey for Efesus, Smyrna, Pergamum, Tiatira, Sardis, Filadelfia and Laodicea.”


God sey, “Na mi bi di Alfa and Omega, di One wey dey since, wey dey naw and wey go still kom, na mi bi di God Almighty!”


E wear klot wey dem soak inside blood and di name wey dem dey koll am, na God Word.


“Make yu rite di tins wey I won tell yu naw, go give di angel for di church wey dey Smyrna: ‘Dis message na from di Pesin wey bi di First and di Last, di One wey die kon kom back to life.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ