34 So, Jesus heal many pipol wey nor well with difren-difren diziz and e drive many demon komot from pipol body. But e nor let di demons tok, bikos dem know who e bi.