Una leaders don rijet mi and na tif bi dia friends; dem dey always kollect bribe from pipol. If pipol wey nor get papa and mama and doz wey dia husband don die bring dia kase kom meet una, una nor dey defend or listin to dem.
So just as lion dey attack oda animals for bush, na so too dia enemies go attack dem and just as wolf bi for desert, na so too dem go distroy dem. Na leopard go dey guide di town and if anybody won kom out from di town, dem go distroy am, bikos dia sin too many and dem don turn from God.
Una bilive sey una get pawa; dey bihave anyhow and evribody dey sleep with who nor bi dia husband or wife. So wetin make una dey tink sey na una get di land?’