Filistia pipol, di kane wey dem take flog una don break, but make dat one nor make una dey happy. If one snake die, di one wey bad pass go take-ova, bikos na dragon go fly kom out from di snake egg.
Wimen wey dia husband go die, go plenty pass san-san wey dey near wotaside. I go kill una yong men for aftanoon kon make dia mama sofa. Na mi make dem dey sofa and fear go katch dem well-well.
Dem go sey, “Make una ready to attack Jerusalem! Make una kom make wi go attack am for aftanoon.” But leta dem go still sey, “E too late, evening don rish and di evening shadow don dey long.