Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Zefanaya 2:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Dis nashon wey nor get shame, make una gada togeda.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Zefanaya 2:1
15 Iomraidhean Croise  

Judah pipol from difren town gada togeda kom sey make God help dem.


All of dem gada for Jerusalem for one hall wey dey di Wota Gate front. Dem kon tell Ezra wey sabi di law sey make e go bring di Law Book wey God give Israel thru Moses.


For di twenty fourt day, for dat same mont, Israel pipol gada to fast, bikos of sins wey dem kommit.


“Go gada all Jew pipol for Shushan, den make una fast and pray for mi. Make una nor chop or drink anytin for three days and nites. Mi and my savants go do di same tin. Afta di fasting, I go-go meet di king, even doh dat kind tin dey against di law. If na dat one go make mi die, den make I die.”


Bikos of dis, God nor allow rain fall, even for di rite time. With all dis tins, una still dey live una ashawo life and shame nor dey katch una.


Shame dey katch dem bikos of di wiked tins wey dem do? No! Dem nor dey shame at-all. Dem nor even sabi form sef! So, dem go die just as odas die. Dem go die finish, afta I don ponish dem.” Mi, wey bi God, don tok.


Koll and tell evribody sey make dem fast! Gada di leaders and all Judah pipol go meet and kry give God for en temple!


But God still dey di town and E nor dey do bad at-all. E dey always judge matter well and E nor dey fail. Yet wiked pipol nor dey shame at-all.


Na one mont I take kill di three oda shepad wey hate mi, bikos I nor like dem too.


Anywhere two or three pipol gada for my name, I go dey der with dem.”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan