8 God sey, “For judgement day, I go ponish Judah leaders, all dia prince and all doz wey dey sin.
Jehu orda di pesin wey dey keep di garments, “Make yu give garment to all dis pipol.” So, e bring garment kom for dem.
But God sey, “Wen I finish wetin I dey do for Mount Zion and Jerusalem, I go ponish Assyria king, bikos e dey proud and e too boast.”
My God, Yu don forget yor pipol wey bi Jakob shidren-shidren, bikos dem dey do majik for evriwhere for di land; dem dey go meet majik pipol just as Filistia pipol dey do and na strenjas bi dia friends naw.
For dat time, God go ponish di wiked spirits wey dey di sky with doz wey dey rule as kings for dis world.
Dem go still karry some of yor own shidren-shidren go do slave work for di king palis for Babilon.’ ”
Dem dey ponish kings and use dia leaders make yeye. Dem dey laf all dia strong-strong towns. Dem dey kover towns with san-san kon seize dem.
Make woman nor wear klot wey bi man own and make man nor wear woman klot, bikos anybody wey dey do dis kind tin, dey make di Oga una God vex.