Zefanaya 1:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
10 God sey, “For dat day, pipol go kry dey kom from di Fish Gate and dem go dey shaut from di new house dem wey dey di town. And una go hear strong nois from di hills.
Afta dem don kapture der, David stay der kon koll am, “David Town.” E build house round am and e start from di dry land go rish di east side for di hill.
So Priest Hilkaya, Ahikam, Akbor, Shafan and Asaya kon go meet Profetes Hulda wey bi Shullam wife. Shullam papa na Tikvah and na Harhas wey dey kare for di wardrobe bi en grand-papa. (Di woman dey stay for Mishneh aria for Jerusalem.) Dem go meet am kon tell am wetin make dem kom,
Solomon kon start to build God Temple for Jerusalem on-top Mount Moraya, di place where God for appear to en papa David, but na Araunah wey kom from Jebus, get der before.
Afta dis, Manasseh build di outside wall for David Town for di west side for Gihon Valley go rish di Fish Gate and di oda gates. E make am high well-well kon put sojas for evriwhere for di town wey dem fence for Judah.
So Priest Hilkaya and di oda pipol wey di king send with dem kon go meet Profetes Hulda wey dey stay di new part for Jerusalem. (En husband na Shallum wey Tokhat born and na Hasrah wey dey kare for di temple robe, bi en grand-papa.) Dem kon tell di woman evritin wey happen,
I hear kry, like woman wey won born; shaut like woman wey dey born en first pikin. Jerusalem pipol dey find as dem go take breath and naw, dem dey kry sey, “Make una help us! Bikos na die wi dey so o-o!”
Dead body go skata round dia juju and en altars; both for dia hill and on-top evry mountin, under evry green tree and evry oak tree and for evriwhere wey dem for dey burnt sakrifice give dia juju. Dat time, evribody go know sey na mi bi God.
“For dat day, na kry and mourning nois go bi di song wey dem go dey sing for di palis. Dead body go dey evriwhere and evribody go kwayet as dem dey go beri dem.”
Dat day, God go vex well-well and di wahala and pain nor go eazy at-all. Dat day go bi to skata and distroy; day wen evriwhere go dark well-well. Yes! Dat day go kom with tick kloud and darkness.
So make una stand for God wey get pawa front, bikos di wonderful day wen God go judge di world, don near. God don prepare to distroy en pipol and E don choose who go kill dem.