den di woman go waka go meet am for di eldas front kon remove en sandal from e leg den spit for en face. Den di woman go sey, “Make dis kind tin happen to any man wey nor gri keep en broda name for Israel!”
(As dem dey do before for Israel, wen dem won setol matter about land or propaty, na tradishon sey di pesin wey won sell go pul en sandal give di pesin wey won buy. Na like dis Israel pipol take dey show sey di matter don setol.)
Den Boaz tell di leaders and evribody wey dey der, “All of una na witness sey, ‘Today I don buy from Naomi, evritin wey bilong to Elimelek and en shidren, Kilion and Mahlon.’