Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Rut 3:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 Wen Boaz don chop beleful, e kon go sleep for di end for where dem gada di rice put. Den Rut small-small waka go der, open en leg kon sleep near am.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Rut 3:7
18 Iomraidhean Croise  

E give dem part for di food wey dem gi-am, but di one wey e give Benjamin, big pass dia own five times. Dem chop and drink with Josef until drink kon katch dem.


kon tell en savants, “Make una look, wen Amnon don drink well-well, den if I give di orda, make una kill-am. Make una nor fear, but get mind, bikos I go take all di blame!”


Jezebel ansa, “Nor bi yu bi di king? Make yu stand up from bed go chop. I go make sure sey yu take Nabot vineyard!”


For di sevent day for di party, di king spirit kon high well-well bikos of di wine wey e drink, so e tell seven of en pesinal savant: Mehuman, Bigta, Harbona, Bizta, Abagta, Zetar and Karkas,


wine wey go make us happy; olive oil wey go make awa skin good and bread wey go give us strent.


Party na to make pesin happy and to dey drink wine dey bring joy, but na money dey ansa evritin!


So I kon sey, nor-tin dey good dan for pesin to chop, drink and enjoy di work wey e dey do, bikos all dis enjoyment kom from God.


So I sey make wi dey enjoy awasef, bikos di only good tin for dis world na to dey chop, drink and enjoy awa short life. Na so wi go take enjoy di happiness and hard work wey God give us to do for dis world.


So, make wi kontinue to chop with joy and drink with happiness for awa heart, bikos God don already asept awa work.


But anytin wey una dey do, weda una dey chop or drink, make una do am to honor God.


Make una nor dey drink strong drink, bikos e go distroy una. But make una allow God Spirit fill una mind.


Many of dem don drink by naw, so dem sey, “Make una bring Samson kom out make e kon make us laf!” So dem bring am kom out from di prison and e stand between di two pila wey dey support di building. Dem kon dey play with am, so dat e go make dem laf.


As dem dey chop and drink, some pipol wey dey kause trobol for di town kon surround di house. Dem bigin nok di door dey shaut for di old man, “Make yu bring di man wey dey stay with yu, so dat wi go sleep with am.”


So di two men sidan kon chop and drink, den di papa kon sey, “Abeg stay for just dis nite make yu enjoy yorsef.”


Afta, wen di man, en girl-friend and en savant dey ready to go, di papa kon sey, “Look, evening don almost rish. Make una stay and enjoy for dis nite, den tumoro morning, una fit get up early kon go.”


So Rut go where Boaz dey kon do evritin wey en moda-in-law tell am make e do.


For mid-nite, Boaz roll kon si sey woman sleep near am!


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan