6 So Rut go where Boaz dey kon do evritin wey en moda-in-law tell am make e do.
Naw, just as Mordekai tok, Estha nor tell anybody sey e bi Jew.
Shidren! Make una respet una papa and mama, so dat una days for di land wey di Oga una God dey give una, go long well-well.
My pikin, make yu listin wen yor papa dey korrect yu and follow wetin yor mama dey tish yu,
Una go bi my friend if una do wetin I tok.
So en mama kon tell di savants sey, “Anytin wey e tell una, make una do am.”
Rut kon ansa Naomi, “I go do evritin wey yu tok.”
Wen Boaz don chop beleful, e kon go sleep for di end for where dem gada di rice put. Den Rut small-small waka go der, open en leg kon sleep near am.