Make nobody shit en Christian broda or make am vex, bikos na God go fight for di pesin wey yu shit and wi don tell una before and wi still dey warn una sey, God go really ponish pipol wey dey do like dat.
Naomi kon tell Rut, “Make God bless am well-well, bikos God always dey keep en promise to doz wey dey alive and doz wey don die!” Naomi kon tell Rut, “Dis man rilate to us and na senior man for awa family.”
But make yu stay here dis nite. Wen day break, if e agri sey e go marry yu, den e good like dat. But if e nor gri, I promise sey as long as God dey alive, I go marry yu. So make yu sleep till day go break.”
Naw, Boaz kon go sidan for di village gate. Wen di relashon wey dey klose to Elimelek dey waka pass; di man wey e tell Rut about, Boaz kon tell am. “My friend, abeg kom sidan for here, bikos I wont tok with yu!” So, e kon sidan.
E good make yu know about am. So if yu wont am, make yu buy am for di leaders present wey sidan here. But if yu nor wont am, make yu tok, bikos na yu get rite to buy first, before mi.” Den di man sey, “I go buy am.”