11 So Rut, make yu nor worry, I go do evritin wey yu ask for, bikos evribody for di village know sey yu bi good pesin.
God appear to am dat nite kon sey, “Na mi bi yor papa Abraham God. Make yu nor fear, bikos I dey with yu. Bikos of my savant Abraham, I go bless yu kon make yor shidren-shidren plenty.”
Good wife dey bring joy and pride to en husband; but wife wey dey bring shame for en husband bi like diziz for en bone.
Who go fit find wife wey get good karata? Good wife betta pass gold.
True-true, I rilate to yor husband, but e get anoda relashon wey dey klose to Elimelek pass mi.