Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Rut 2:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 For dat time, Boaz kom Betlehem kon greet di workers sey, “Make God dey with una!” Dem ansa, “Make God bless yu too!”

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Rut 2:4
21 Iomraidhean Croise  

I don choose am, so dat e go kommand en son and shidren-shidren sey make dem obey mi kon do wetin dey good and korrect. If dem obey mi, I go do evritin wey I promise am.”


God wey get pawa well-well go always bless yu! E go make yu dey fruitful kon give yu plenty shidren! Den yu go bi very big nashon.


Salma wey bi Betlehem papa, naim still born Haref wey bi Bet-Gada papa.


Make una bless di pesin wey dey kom with God name. Yes! Wi bless Yu from God house.


Make God wey kreate heaven and eart bless una from Zion!


Israel God wey dey rule evribody sey, “Wen I don bring di pipol kom back to dia land, dem go tok for Judah sey, ‘Make God bless Jerusalem hill; di holy place wey E dey stay.’


“ ‘ “God go bless and protet una;


Di angel kon tell am, “I salot yu o-o! Yu wey God don favor, bikos E dey with yu.”


Naw, make Christ wey dey give peace, give una en peace evritime and make di peace dey with una always.


Make una nor disobey una masta, bikos dem bi bilivers. But make una serve and love dem well, bikos di mastas wey una dey serve, na Christian dem bi. Timoti, make yu tish dis tins and dey enkourage evribody to obey am.


Make Christ dey with yor spirit. Make God grace and favor dey with yu.


If una sey una nor won woship God, den today-today, make una choose who una go woship, weda na una grand-grand papa gods wey dey di oda side for di river, or Amor pipol gods wey dey di land wey una dey stay so. But for mi and my whole house, na di Oga awa God wi go woship and serve till wi die!”


Di angel appear to am kon sey, “Strong man, God dey with yu!”


Den di angel tell am, “Yu go fit do am, bikos I go dey with yu and yu go distroy Midian pipol like sey yu dey fight one pesin.”


So Rut kon go gada rice for di field wey bi Boaz, wey kom from Elimelek family, own.


Wen Boaz si Rut, e kon ask en savant wey dey show dem wetin to do sey, “Na where dis woman from kom?”


Den all di eldas wey dey di gate kon sey, “Yes! Wi bi witness. Make God make yor wife bi like Rashel and Leah, wey born many pikin for Jakob. Make yu get plenty money for Efrat and evribody go know yu for Betlehem.


David still sey, “God wey diliver mi from di lion and di bear, go still diliver mi from dis Filistia man hand!” Den Saul kon tell David, “Make yu go fight am and make God dey with yu.”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan