16 Apart from dat, make una put many rice head for groun, so dat e go si gada and make nobody stop am!”
Dem dey share and give wetin dem get to poor pipol for free. Pipol go always remember dia good work forever. Dis kind pipol, go get respet and honor.
Wen yu give sometin to poor pipol, e bi like sey God dey borrow from yu and God go pay yu evritin wey E borrow.
“Den di king go ansa, ‘I tell una true word, just as una do am give di pesin wey small pass among my brodas and sistas, una don do am for mi.’
Make una give food to God pipol wey dey hongry and make una dey welkom dem for una house.
I get joy and my heart dey strong bikos of yor love and thru yu, all God pipol heart don strong too.
God nor dey support pipol anyhow. E go remember how una help en pipol before-before and how una still dey help dem naw. Una bi God pipol and E nor go forget di love wey una show en shidren.
Wen Rut stand up won go gada rice, Boaz kon tell en savants, “Make una let am gada rice for where rice many and make una nor stop am!
So Rut kon gada rice for di farm till evening. So, wen Rut look all wetin e gada, e heavy rish three pounds!