So Naomi kon decide sey e go-go back to Betlehem (and en shidren wifes follow am), bikos as e dey for Moab, e hear sey God don bless en pipol and honga nor dey dia land again.
Naomi kon tell di wimen, “Make una listin to mi! Make una go back to una mama house! Make God show una en favor just as una don show am to mi and my shidren wey don die!