6 So Naomi kon decide sey e go-go back to Betlehem (and en shidren wifes follow am), bikos as e dey for Moab, e hear sey God don bless en pipol and honga nor dey dia land again.
Den Israel bless Josef kon sey, “Make di God wey yor grand-papa Abraham and Isaak serve; di God wey dey guide mi since thru-out my life kon rish today;
“So make yu go gada di eldas for Israel kon tell dem sey, ‘God wey bi una grand-grand papa dem, Abraham, Isaak and Jakob God appear to mi kon sey, “I don kom meet una and I si as una dey sofa.
Di first one na: Help mi make I nor dey lie and deceive pipol and di sekond one na, make Yu nor make mi too rish or too poor! Make yu give mi di tins wey go rish mi use.
Doz wey remain for Judah go stay for der. Dem go stay and dey chop for di house wey Ashkelon pipol run leave. Oga God go visit en pipol with kindness and make dem prosper again.
So make una dey live well among pipol wey nor bi Christian, so dat wen dem sey una do bad, dem go si di good tins wey una dey do and dem go praiz God wen E won judge di world.