4 So di shidren marry wimen from Moab and dia name na Orpah and Rut. Dem kon stay for Moab for anoda ten years.
For dat time, I notis sey many among Jew men marry wimen from Ashdod, Ammon and Moab town.
Salmon born Boaz (wey Rahab bi en mama), na Boaz bi Obed papa (wey Rut bi en mama), Obed kon born Jesse,
Make no Ammon or Moab pesin enter God present; even to dia tent generashon, make nor of dem enter where God dey.
Make una nor even marry from dem. Make una nor let una pikin marry dia pikin,
Afta sometaim, Naomi husband, Elimelek kon die leave di woman and en two pikin.
Den Naomi two sons, Mahlon and Kilion kon die too. So Naomi nor get husband or shidren again.