7 But disgrace dey follow pipol wey dey woship juju; doz wey dey make mout about dia god wey nor bi anytin, bikos evry oda god must bow before di Oga awa God.
All dis bad tins kon turn di pipol to fool and dem nor get sense again. So, disgrace go follow doz wey dey make juju, bikos di juju na lie-lie and dem nor get life at-all.
So God sey, “Just as dem dey disgrace tif wen dem katch am, na so too I go disgrace Israel pipol, dia kings, ofisas, priests and profets, bikos of wetin dem do.
‘Anybody wey make juju or image to woship, na curse go follow dat pesin, bikos juju wey human being dey make, na sin to God. Den all di pipol go ansa, “Amen.”
Dem show sey nor bi demsef dem dey work for, but na for una, bikos una hear dis matter from di apostles thru di Holy Spirit pawa wey kom from heaven. Even angels dey wish sey dem know dis tins.