I go tell evribody about yor raitiousness and evriday, I go always dey tok about di pawa wey Yu take dey save, even doh I nor really fit esplain how e bi.
So Jerusalem, make yu go on-top high mountin. Make yu prish di good news! Koll Zion pipol with loud vois, den announce di good news! Shaut as yu dey tok and nor fear at-all. Make yu tell Judah towns sey God dey kom!
So my brodas, wey bi Abraham shidren and una wey bi Gentile pipol wey dey fear God, na di message about how God go take save pipol, naim wi kom tell una so.
Den I hear evritin wey God kreate for heaven, eart, under eart, sea and evritin wey dey inside dem dey sing sey: “Make praiz, honor, glory and pawa to rule, bi di Pesin wey sidan for di throne and di Lamb own, forever and ever!”