9 Una tink sey di Pesin wey make una ear nor dey hear word? Abi di Pesin wey make una eye nor dey si?
But God dey for en holy temple; E dey rule from heaven. E dey look as evribody dey live dia life for dis eart.
Na nite wen I dey sleep Yu take test my mind kon shek my heart. Yu don shek mi kon si sey I nor dey wrong. I don sey I nor go sin with wetin I dey tok or do.
But God dey trowey en face from doz wey dey do bad tins; E dey remove dem from dis eart.
E go know, bikos E know wetin dey evribody mind.
God ask am, “Na who give man mout or na who dey make pesin fit tok, hear or si? Nor bi mi wey bi God?
Too mush drink dey make pesin tok and bihave anyhow and pesin wey dey drink too mush, nor get sense.
Na God give us eyes to si tins and ear to hear word.
Make una nor tink sey God dey too weak to save una or dey deaf to hear wen una koll am for help!
I hear as una dey make mout and curse mi.
If to sey di whole body na eye, wi nor for fit hear anytin and if to sey all di body na ear, wi nor for fit smell anytin.