Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 94:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 But una wey bi fool, make una tink again! Wen una go really get sense to undastand?

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 94:8
12 Iomraidhean Croise  

Wi know sey even wise pipol must die; both fools and doz wey dey spiritual still dey die too and na odas go kollect evritin plus di money wey dem get.


I bin dey do like fool wey sturbon. I know sey for yor present, I bin look like animal wey nor get sense.


Who nor get sense nor go fit know wetin Yu dey do and na only fools nor go undastand sey:


Pipol wey nor get sense, na how long una won take bi fool? Na how long una won take wisdom do yeye? Una nor won learn at-all?


Pesin wey dey happy wen dem korrect am, get wisdom, but anybody wey dey vex wen dem korrect am, nor get sense.


Una wey nor know anytin, make una get wisdom. Una wey nor wise at-all, make una try get sense.


Di pipol bi like trees branches wey don dry and skata for groun; wey wimen dey gada take do firewood. So, bikos di pipol nor undastand anytin, God wey kreate dem nor go sorry or pity for dem.


Evribody for dis world na fool and dem nor get sense. Wetin dem fit learn from juju wey dem make from wood?


Nobody dey wey wise or undastand God.


How I wish sey dem get sense and fit undastand dis tins or know wetin go happen to dem.


Before naw, wi dey bihave like fool; wi nor dey obey; wi dey deceive pipol; wi bi savant to tins wey dey sweet us; wi dey do bad tins and dey jealous odas; pipol hate us and wi hate dem too.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan