Pipol wey dey try to hide dia plans from God, nor betta pass doz wey don die! Dem dey hide do dia work for korna, dey tink sey nobody dey si or know wetin dem dey do, bikos dem dey boast sey, “Who dey si us? Who know wetin wi dey do?”
Yu trust yor wikedness kon sey, ‘Nobody dey si mi.’ Yor wisdom and di sense wey yu get dey deceive yu wen yu sey, ‘I dey special and nobody bi like mi.’
God kon ask mi, “Man pikin, yu si wetin Israel leaders dey hide do? All of dem dey woship for one room wey juju full. Dem dey sey, ‘God nor dey si us! E don leave dis land.’ ”
God ansa, “Israel and Judah pipol don sin well-well. Dem don kill pipol for di land and dem nor dey obey my law again. Dem sey mi God don leave dem and I nor dey si wetin dem dey do.
I go use lantan take find all Jerusalem korna wey darkness pass, so dat I go ponish doz wey love to sin. Dem bilive sey God nor go fit do dem anytin; weda good or bad.