Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 92:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 But doz wey dey fear God, go prosper like bambo tree and dem go strong as dem dey grow like cedar tree for Lebanon.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 92:12
17 Iomraidhean Croise  

E rite about trees and plants, like di cedar wey dey Lebanon and di plant wey dey grow for wall. E still rite about animals, birds, animals wey dey creep and fish.


Dem use creatures wey dem karve with feadas, palm tree and flower, take dekorate di wall both for inside and outside.


So Jew pipol attack all dia enemies with swod kon kill dem well-well. Dem do wetin dem like with dia enemies.


E bi like tree wey dem plant near wota; wey dey bear fruit for di korrect time and en leaf nor dey dry. E dey prosper for anytin wey e do.


God send rain give en tree make dem for dey grow well; di cedars for Lebanon wey E plant.


Mountins and all di hills; trees and all di cedars;


So make yu put yor hope for Oga God. Make yu dey always waka for en ways and E go honor yu wen E give yu dis land, den yu go si as E dey distroy wiked pipol.


But I bi like olive tree wey dey grow well inside God house. I go always trust God love wey nor dey fail.


All di pipol wey dey fear God go prosper as di king dey rule. So make goodness follow dem, as long as di moon dey shine for di sky.


“Wiked pipol dey grow like grass and doz wey dey do evil dey prosper, but God go distroy dem forever.”


Cypress trees go grow for where grass dey naw. Myrtle trees go grow for where shuku-shuku dey. Dis sign go dey forever and e go dey remind una about wetin mi wey bi God don do.”


Anoda pesin nor go stay inside di house wey dem build and odas wey nor plant, nor go drink di wine wey my pipol make, bikos my pipol go get long life like tree and dem go enjoy evritin wey dem work for.


Dem go bi like tree wey dem plant for near river wey en rut spread enter di wota. Dem nor dey fear wen hot weda kom and dia leaf dey always green; dem nor dey borda if rain nor fall and dem dey always bring fruit.


I distroy Amor pipol, bikos of my pipol; men wey tall like cedar tree and get pawa like strong tree. I distroy di fruit wey dey dia tree kon skata di rut for groun.


Den my enemies go si sey God dey for my side and shame go katch dem. Dis na di same enemies wey ask sey, “Where dat yor Oga God dey?” And naw, I go si as dem dey fall and I go mash dem pass like portor-portor for road.


Dem bi like long valley; like gardin wey dey near wotaside. Dem bi like aloe wey God plant and cedar tree wey dem plant near wota.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan