11 My eyes don si my enemies dey fall and my ear don hear as God win doz wiked pipol.
Dem get mind and dem nor dey fear as dem dey fight and distroy dia enemies.
Dem dey share and give wetin dem get to poor pipol for free. Pipol go always remember dia good work forever. Dis kind pipol, go get respet and honor.
E dey give mi food to chop for my enemies present. E pour oil for my head and my cup kon full dey trowey.
So make yu put yor hope for Oga God. Make yu dey always waka for en ways and E go honor yu wen E give yu dis land, den yu go si as E dey distroy wiked pipol.
Yu save mi from my trobols kon help mi defeat my enemies.
My God wey love mi go help mi. E go make mi happy, bikos I win my enemies.
Una go si am with una own eyes! Yes, una go si as God dey ponish wiked pipol.