Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 91:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 E go kover yu with en feada and na der yu go dey save. Na en promise wey nor dey fail, dey guide and protet us.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 91:4
14 Iomraidhean Croise  

Afta all dis tins, God tok to Abram for vishon: “Abram! Make yu nor fear! Na mi dey guide yu and yor reward go big well-well.”


I bow kon woship Yu for yor holy temple. I dey praiz yor name, bikos of yor faithfulnes and love wey nor dey fail; bikos Yu don make yor promise and e high pass di sky.


Make Yu protet mi as pesin dey protet en own eye. Make Yu hide mi under yor feada.


Make Yu wear yor war klot, ready for war, den kom save mi.


My God, make Yu sorry for mi. Abeg, sorry for mi, bikos na Yu dey protet mi. I go hide under yor shadow until I don free from all dis wahala.


Make Yu let mi stay yor temple forever, den I go dey save under Yu.


“O! Jerusalem pipol, O! Jerusalem pipol! Una wey kill di profets and stone di pipol wey God send kom meet una! I don dey try to gada una shidren as fawol dey gada en shidren under am, but una nor let mi do am.


Heaven and eart go vanish, but my word go dey forever.”


Just as di eagle dey wosh en house kon kover en shidren, na so too God spread en feada kon karry dem go up.


Di trut dey give dem di mind sey dem get life wey nor dey end and na God wey nor fit lie promise dem dis life even before E kreate di world.


God go bless yu for evritin wey yu dey do! Di Oga wey bi Israel God wey dey protet yu, go pay yu for all di good tins wey yu don do!”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan